Subscribe Us

header ads

Grammy awards 2021 winners: Burna Boy, Beyoncé & Wizkid, Kanye and Others win 63rd Grammy Awards

Burna Boy don collect im first ever Grammys Best Global Music Awards for "Twice as Tall".

For im acceptance speech, Burna Boy tell pipo make dem believe in themselves as im tok say "Africa don land."

Dis na di first time wey Nigerian go win for dis category.

Burna Boy, age 29 wey real name be Damini Ogulu, bin dey nominated last year for im African Giant album but na Angelique Kidjoe in gbab am.


 

 Wizkid name don join di list of Grammy Winners as im join BeyoncĂ© and Blue Ivy to gbab award for di Best Music Video for Brown Skin girls.

Beyoncé become di performing female artist wit di most career Grammy wins ever, totalling 28.

Dis go be di first time di Nigerian super star dey gbab di award. Dis dey come as Burna Boy, wey dem born for Port Harcourt Nigeria, bin perform for di first time for di Premier Ceremony.

Di Nigerian Afrobeats stars Burna Boy and Wizkid collect di awards for di Premier Ceremony wey dey come before di main di main Grammy Awards.

Dis na wia dem dey give some of di awards wey dem fit no get time for, for di main awards.

Di Premier Ceremony dey come about six hours before di main 63rd Grammy Awards ceremony go start.

Di show wey Jhene Aiko host also feature Kanye West wey win di Best Contemporary Christian Music Album for im Jesus Is King Album.

Dis dey come afta video bin comot of am wen im dey piss for inside di award plaque for September 2020.

Taika Watiti also collect di award for best Soundtrack compilation for im work for di cartoon Jojo Rabbit.

    Oxford AstraZeneca vaccine side effects Lagos Health Commissioner reveal

Oda winners for [63rd Grammy Awards] Premiere Ceremony include:

Billie Eilish for di song "No Time Left To Die" wey she follow write with her brother, Finneas Baird O'Connell.

Lady Gaga and Ariana Grande win Best Pop Duo/Group Performance winner wit 'RAIN ON ME'

John Legend gbab di Best R&B Album for Bigger Love


 

Taylor Swift take home di massive Album Of The Year win for 'folklore' for di 2021 Grammys

Record Of The Year winner na "everything i wanted" - by Billie Eilish

Dua Lipa 'Future Nostalgia' win Best Pop Vocal Album for di 63rd Grammys

With "I Can't Breathe" H.E.R takes home Song Of The Year Grammys

Anderson Blacked take home Best Melodic Rap Performance at the 63rd Grammys

Best Rap Song winner na "Savage" Megan Thee Stallion and Beyonce

American rapper Megan Thee Stallion take home Best New Artist for di 2021 Grammys.

Puerto Rican superstar Bad Bunny take home Best Latin Pop Or Urban Album For 'YHLQMDLG' for di 2021 Grammys

Nas win Best Rap Album winner wit 'KING'S DISEASE'

Justin Bieber PLUS Dan And Shay win di Best Country Duo/Group Performance winner - "10,000 HOURS" 


Dolly Parton and Zach Williams win Best Contemporary Christian Music Performance/Song winner wit -"THERE WAS JESUS"

Jazz Vocal Album Solo winner - 'SECRETS ARE THE BEST STORIES' - by Real Kurt Elling ft. Danilo Perez

Best Jazz Instrumental Album winner - 'TRILOGY 2' - by Chick Corea, Mcbrides World, Brian Blade

Best Large Jazz Ensemble Album winner - 'DATA LORDS' - Schneider Maria

Best Latin Jazz Album winner - 'FOUR QUESTIONS' - by Arturo O'Farrill & The Afro Latin Jazz Orchestra

Best Traditional R&B Performance winner - 'ANYTHING FOR YOU' - by Ledis

Best R&B Song winner - "BETTER THAN I IMAGINED" - by Robert Glasper, H.E.R

Best Progressive R&B Album winner - 'IT IS WHAT IT IS' - Ashy Daddy

Best Alternative Music Album - 'Fetch the Bolt Cutters' - Fiona Apple

Fiona Apple also win Best Rock Performance winner wit 'SHAMEIKA'

Best Traditional Pop Vocal Album winner - 'AMERICAN STANDARD' - by James Taylor

Best Metal Performance - 'BUM-RUSH' by Body Count Band

Best Rock Song winner - 'STAY HIGH' Brittany Howard

Best Rock Album winner - 'THE NEW ABNORMAL' - by The Strokes

Best Country Solo Performance winner - 'WHEN MY AMY PRAYS' - by Vince Gill

Best Country Song winner - 'CROWDED TABLE' - BrandiCarlile, , Natalie Hemby, Lori McKenna, and The Highwomen

Producer Of The Year, Non-Classical winner - Na WATT pocket am

Best Classical Solo Vocal Album winner - 'SMYTH: THE PRISON' EXO_Orchestra, Sarah, Dashon Burton, Blachly James

Best Arrangement, Instruments And Vocals winner - 'HE WON'T HOLD YOU' - by Jacob Collier

Best Pop Solo Performance winner na Harry Styles

Country powerhouse Miranda Lambert wIn Best Country Album for 'Wildcard' for di 2021 Grammys.



Post a Comment

0 Comments